Lagos State goment say dem don begin dey comot Okada riders for di Lekki axis of di state and don already arrest 123 riders so far.
Dis dey come days after some riders allegedly burn one sound engineer to death over misunderstanding.
Di state commissioner of information Gbenga Omotosho inside one statement on Monday call for calm as e promise say goment go make sure say justice go dey served.
Police don arrest four pipo ontop di mata.
Source: BBC PINGIN